Wetin
you
be
I
no
just
send
you,
rat
wey
celebrate
inside
bag
of
rice
no
fit
becom
cat.
Rat
wey
sey
he
resemble
cat
no
fit
do
breaking
dance
whia
cat
dey
sleep.
Dem
neva
born
dat
kind
rat.
Lizard
no
be
crocodile,
goat
no
be
antelop.
Wetin
you
no
be,
you
cant
becom.
Na
head
wey
wise,
dey
get
gray
hair,
na
leg
wey
strong
dey
go
far,
na
pikin
wey
sabi
sometin
de
follow
elders
dey
chop
food.
Na
rat
wey
wise
dey
get
plenty
underground
holes.
No
go
challenge
de
river
for
contest.
A
community
of
Ten
thousand
rats,
na
cat
still
be
the
king.
De
war
wey
mouth
fight,
if
leg
rich
dia,
he
no
go
com
back.
Crocroach
dey
dance
disco
becos
fowl
no
dey
house.
Hunga
go
humble
you,
povaty
go
teach
go
teach
you
hard
lessons
wey
school
no
fit
teach
you,
na
who
see,
na
him
go
learn.
Na
head
wey
wise,
dey
get
gray
hair,
na
leg
wey
strong
dey
go
far,
na
pikin
wey
sabi
sometin
de
follow
elders
dey
chop
food.
Na
rat
wey
wise
dey
get
plenty
underground
holes.
No
go
challenge
de
river
for
contest.
Rat
wey
dey
boast
for
radio,
no
fit
try
am
in
reality
where
cat
na
him
be
de
president.
Dem
no
dey
tell
small
pikin
sey
make
him
no
touch
fire.
How
he
wan
take
learn
lessons
de
hard
way.
Life
no
soft,
ground
no
wet,
everytin
hard
na
why
dey
call
am
hard
way.
Rat
wey
challenge
cat
don
die
since
de
time
of
Lord
Lugard.
No
your
size,
commot
bodi,
if
de
mata
no
concern
you.
Wata
must
find
him
level.
Pesin
wey
sabi
him
level
no
dey
kollect
enihow
beating.
Rat
no
fit
get
discharge
and
acquitted
whia
cat
be
de
judge,
jury
and
executiona.
E
go
hard
for
de
rat
wey
no
get
sense.
Com
tough
for
lizard
wey
dey
challenge
crocodile.
Na
head
wey
wise,
dey
get
gray
hair,
na
leg
wey
strong
dey
go
far,
na
pikin
wey
sabi
sometin
de
follow
elders
dey
chop
food.
Na
rat
wey
wise
dey
get
plenty
underground
holes.
No
go
challenge
de
river
for
contest.
No
talk
sey
nobodi
yarn
you
sey
ocean
no
be
stream,
plantain
stem
no
be
palm
tree.
Buttafly
wey
dey
challenge
bird,
no
know
sey
beta
wind
go
blow
am
put
for
corna.
Plenty
lessons
dey
for
de
head
wey
wan
learn.
Na
longa
throat
make
rat
kpai
inside
trap,
na
see
finish
kpai
crocroach.
Dey
call
cat
family,
rat
com
dey
raise
hand,
no
be
suicidal
hand
be
dat.
Life
na
jeje,
uwa
bu
nwayo,
nwayo.
Onye
kpa
karia
chiya
noso,
he
go
kpai
untimely.
No
go
price
market,
wey
you
no
fit
buy,
no
go
challenge
gods
wey
dey
feed
you.
No
start
fight
wey
no
concern
you.
No
claim
wetin
you
no
be.
Rat
no
be
cat,
Tillapia
no
be
shark,
cat
no
be
tiger.
Sey
dem
resemble
no
mean
sey
dem
be
de
same.
Na
head
wey
wise,
dey
get
gray
hair,
na
leg
wey
strong
dey
go
far,
na
pikin
wey
sabi
sometin
de
follow
elders
dey
chop
food.
Na
rat
wey
wise
dey
get
plenty
underground
holes.
No
go
challenge
de
river
for
contest.
De
ear
wey
no
gree
hiar
wetin
wey
de
head
dey
reason
wit
am,
dey
kpai
wit
de
head
wen
dey
cut
am
down.
Monkey
sabi
run,
na
becos
tree
nia
tree.
Life
soft
for
de
rat
wey
sabi
him
limit,
life
com
sweet
for
lizard
wey
choose
wall
instead
of
de
river.
No
form
tiger,
wey
you
no
be
tiger,
no
be
to
form
craze,
na
trekking
be
de
wahala.
Rat
no
be
cat,
sokoto
no
be
Sokoʻtoʻ,
ekpe
no
be
ékpe.
No
your
lane,
mind
your
business.
Na
so
we
see
life,
my
broda.
Na
head
wey
wise,
dey
get
gray
hair,
na
leg
wey
strong
dey
go
far,
na
pikin
wey
sabi
sometin
de
follow
elders
dey
chop
food.
Na
rat
wey
wise
dey
get
plenty
underground
holes.
No
go
challenge
de
river
for
contest.